Wetin be Disease X and enof preparation dey for di next pandemic?

A masked female researcher looking at a computer screen in a lab environment

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For future, scientists suppose fit use "vaccine recipes" wey already dey ground to make new vaccines

Health industry leaders for di World Economic Forum for Davos, Switzerland, don dey tok on top di importance to plan for anoda outbreak of global pandemic, wetin dem call "Disease X".

Di World Health Organization (WHO) don already warn before say di preparation dey important to take avoid di kain kasala wey di Covid 19 pandemic bin cause.

Di pandemic bin ova take medical systems wey bin no fit cope and di economy bin lose trillions of dollars.

Wetin be Disease X?

Na hypothetical term wey WHO adopt to refer to some currently unknown infectious condition wey dey capable of causing epidemic or – if e spread across multiple kontris or continents – a pandemic.

Di term gan-gan bin start before di Covid 19 pandemic. E bin dey di list of priority diseases wey WHO bin bring come outside for 2018.

Di R&D Blueprint na global strategy wey sabi pipo bin collabo to put togeda. Na WHO bin arrange dis collaboration to make sure say preparation plans dey.

Di preparation na to make sure activation of research and development activities for epidemics happun sharparly.

Di reason behind am na to sharparly speed di reach of beta tests, vaccines and medicines wey fit save lives and avoid ogbonge kasala.

We don see some global disease outbreaks recently: Sars (Severe Acute Respiratory Syndrome), swine flu, Mers (Middle East Respiratory Syndrome), Ebola and Covid-19.

Health sabi pipo fear say di next major pandemic fit dey road dey come and fit worse pass wetin di Covid-19 do.

WHO chief Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus speaks at a World Economic Forum panel in Davos on 17 January 2024

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus addresses world leaders for Davos

Shey Disease X fit cause pandemic?

While Disease X no dey known say e de ground already, researchers, scientists, and sabi pipo hope say dem fit first am to come up with plan to fight di virus and prepare di health system if e turn pandemic.

For di World Economic Forum last week, one panel wey dem call “Preparing for Disease X" wey WHO oga Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus bin lead tok about di "novel efforts wey dey needed to prepare healthcare systems for di multiple challenges ahead" if pandemic wey dey more deadly happun.

"Pipo dey wey say dis fit create panic. E dey beta to prepare for somtin wey fit happun becos e don happun for our history many times."

Di Covid 19 pandemic shock di world but as BBC Future tok for 2021, "but for years epidemiologists and oda sabi pipo don dey warn say we dey arrange for global pandemic."

Most of dose sabi pipo dey worry how di pandemics dey come from animals.

In fact 75% of new diseases wey dey come up dey called zoonotic, wey dem dey call diseases wey dey spread from animals reach human beings.

Covid 19 wey dey thought to come from pangolins wey dem dey sell for markets for China no dey different. But like Covid 19, zoonotic diseases don be like say e dey more at risk becos of wetin humans dey do.

Humans effect on climate, how dem dey enta wildlife house and global travel bin help di spread of animal borne diseases.

Dat one plus urbanisation, overpopulation and global trade, don make am di perfect setting for more pandemics to come, na wetin some sabi pipo believe.

Two hands in gloves holding up a syringe needle going into a vaccine vial top

Wia dis foto come from, PA

Wetin we call dis foto, Di first Covid-19 vaccine bin dey delivered outside of a clinical trial setting for early December 2020

How di world dey take prepare for di next pandemic?

Dr Tedros tok for di World Economic Forum panel session say WHO don already start to dey implement measures to take prepare for anoda outbreak.

Dis include pandemic fund and "technology transfer hub" for South Africa wey go ginger di local production of vaccines and go help overcome issues of vaccine inequality throughout rich and poor kontris dem.

Di European Centre for Disease Control and Prevention recommend for 2022 report to strengthen existing systems instead of developing new ones for pandemic.

Dem also encourage make dem test any new systems before new pandemic start.

For June 2022, di WHO publish 10 proposals to ginger di continuous, systematic collection, analysis and interpretation of health-related data.

Di proposal say, "effective disease surveillance system dey important to find disease outbreaks sharp before dem spread, cost lives and become hard to control".

Di WHO also gree say di outbreaks no always dey come from identified source but "fit dey caused by pathogen wey neva dey sighted as somtin wey fit cause human diseases."

And most pipo dey hope for more advances for vaccine technology.

Plenti Covid 19 vaccines bin dey available all ova di world wit di year wey di outbreak start, wey be ogbonge moment for vaccine development sake of di speed wey dem make dem.

For future, scientists for dey able to quick arrange existing "vaccine recipes" to create new ones to help protect pipo.