Govnor Yusuf reinstate Sanusi Lamido Sanusi as Emir of Kano - how e happun

Aminu Ado Bayero and Sanusi Lamido

Wia dis foto come from, AMINU ADO BAYERO/INSTAGRAM/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, L-R Aminu Ado Bayero and Sanusi Lamido

Govnor Abba Kabir Yusuf don remove Emir of Kano, Aminu Ado Bayero, and di oda four emirs for di state, and don put Sanusi Lamido Sanusi back as Emir of Kano.

Di govnor announce dis one for one press conference wey e hold for Goment House, wia e sign di new law wey di Kano State House of Assembly pass, wey dissolve all five emirates for Kano and remove di emirs.

For im speech on Thursday, 23 May, di govnor tok say: "E dey necessary to bring back di tradition wey don dey for Kano for ova 900 years, so we don cancel di 2019 law wey create extra emirates during former govnor [Ganduje] time."

Di govnor instruct di five dethroned emirs to quickly hand ova dia offices to di correct authorities for di state.

Dis decision come less dan seven hours after di Assembly approve di law wey cancel di 2019 law wey former govnor Abdullahi Umar Ganduje make, wey create five emirates for Kano.

On Friday, 24 May, di Kano State House of Assembly go do di first reading of a bill to downgrade di oda four emirates to second-class status.

Finally, di govnor beg di pipo of Kano to remain calm and continue dia daily activities.

Govnor Abba Kabir Yusuf
Wetin we call dis foto, Govnor Abba Kabir Yusuf sign di new law wey Kano State House of Assembly pass

Earlier, di lawmakers bin debate di mata on Thursday, 23 May bifor dem agree to cancel di old law and go back to di single emirate wey don dey for Kano for ova 900 years.

"We don cancel di law wey create di five emirs for Kano, wey mean say no emir dey for Kano entirely again." Di majority leader for di assembly, Lawan Hussaini Dala, tok dis one for interview wit BBC.

E add say di assembly don dissolve all di five emirates, meaning say no emir go dey for Kano once di govnor sign di law.

E explain say di oda emirates don downgrade to second-class status, and di new law go get di first reading.

Kano state House of Assembly

Ayuba Labaran, di leader of di minority members for di assembly, waka commot from di session afta di speaker suspend am for criticizing di motion.

Labaran tok say, "Dem dey claim say di emirate don dey for ova 900 years, but if we look back, di population of Kano no go don pass 200,000 pipo."

E add say wen dem introduce di law to create extra emirates for Kano during Ganduje tenure, di four areas wey dem create new emirates see progress in terms of infrastructure and oda amenities.

Ayuba Labaran
Wetin we call dis foto, Ayuba Labaran, minority leader for Kano assembly

Bifor di govnor reinstate Sanusi Lamido Sanusi, Kano State House of Assembly bin propose to amend di law wey divide di Kano Emirate into five smaller emirates wey dem implement for 2019.

Di Assembly carry di amendment issue afta Minority Leader Lawan Hussaini Dala, present di motion for Assembly on Tuesday, and dem read am for di first time on Wednesday.

For 2019, former govnor of Kano state Abdullahi Ganduje, present one bill for di State House of Assembly to create four new emirates.

But, di court reject di creation of di four new emirates, say dem no follow procedure to make di law.

For May dat year, govnor Ganduje sign di bill into law, create di new emirates of Gaya, Rano, Karaye, and Bichi - all of dem get district heads under di Kano Emirate.

For di same month, e remove di 14th Emir of Kano, Sanusi Lamido Sanusi, and appoint new emirs for di newly created emirates.

Kano state House of Assembly

Despite dis, di Kano state goment claim say dem no receive any official court order to stop di creation or di appointment of di new emirs.

Di former govnor tok say di reason for creating di new emirates dat time na to unify di community, improve security, and promote development for Kano State.

Di Commissioner for Information under Ganduje administration, Muhammed Garba bin explain say some of dis emirates dey bifor di Kano Emirate, and dis move na effort to revive dem.

Di law get 51 provisions, as di Kano State House of Assembly tok during di amendment process for 2019.

Some key provisions inside di old law include;

  • Di govnor go get power to select di chairman of di council of emirs to be established later.
  • Di governor go appoint kingmakers wenever di need arise.
  • Any Emir wey di govnor choose to lead di council of emirs go serve for two years.
  • Any emir wey fail to attend di council meetings three times witout valid reason go lose im throne.

Bifor di 2019 law, na di colonial "Emirs Deposition and Appointment" law dem dey use remove emir from im throne and send am to anoda town.