Williams penalty saves help South Africa defeat DR Congo to finish third for Afcon

Ronwen Williams

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Williams bin save four penalties for di quarter-final against Cape Verde

Ronwen Williams penalty saves help South Africa overcome DR Congo 6-5 on penalties to finish third for di 2023 Africa Cup of Nations.

Williams wey bin help Bafana Bafana reach di semi-final of di tournament through im heroics against Cape Verde wia im save four penalties step up again to deny Meschack Elia and Chancel Mbemba kicks during di shootout.

Both sides bin fail to produce clear-cut chances during regulation time.

DR Congo create di most chances first from Silas, den Wissa and Mayele but all three of dem fail to hit di target.

Mayembela for also open di scoring for South Africa in di second half but di forward shoot im shot straight at di goalkeeper from just inside di area.

During di shootout, Mokoena bin miss di first kick for South Africa wey give DR Congo di advantage.

DR Congo score dia first four kicks and bin only need Mbemba to score di fifth one for dem to win di game. Williams dive low to im right to save di shot from di DR Congo captain to send di shootout into sudden death.

Afta Xulu score di sixth kick for South Africa, Williams again save Elia shot to hand victory to Bafana Bafana.

Dis na di second time wey South Africa go finish third for Afcon afta dem do am in 2000.

Penalty shootout

South Africa win DR Congo 6-5 on penalties to finish third.

Elia to take...e don miss as Williams save im kick.

Xulu send di keeper di wrong way. South Africa 6-5 DR Congo

Wissa score im penalty kick. South Africa 5-5 DR Congo.

Appolis strike di shot low into di corner, advantage South Africa. South Africa 5-4 DR Congo.

Mbemba kick dey saved by Williams. South Africa 4-4 DR Congo. Dis shootout don enter sudden death.

Now if DR Congo score dis shootout don end.

Lepasa send di goalkeeper di wrong way to score. South Africa 4-4 DR Congo.

Kayembe cooly score im kick as im shoot straight again beyond Williams. South Africa 3-4 DR Congo.

Modiba left foot shot go in, di goalkeeper follow am but e no fit stop am. South Africa 3-3 DR Congo

Bakambu score im kick wey im shoot straight. South Africa 2-3 DR Congo

Monare manage to shoot di ball beyond Bertaud reach and score. South Africa 2-2 DR Congo.

Mfulu don step up, im shoot straight down di middle. South Africa 1-2 DR Congo.

Sibisi shoot to di right and im score South Africa 1-1 DR Congo.

Moutoussamy shoot high into di net. South Africa 0-1 DR Congo.

Mokoena miss di first kick for South Africa. Im shot hit di goalkeeper right-hand post.

Mudau and Tshibola challenge for ball

Wia dis foto come from, Getty Images

Second half

FT: South Africa 0-0 DR Congo

90+3 mins - Wissa wit anoda opportunity to score...o no im jab di ball from a cross go over. Penalties na im go settle dis game.

90 mins - Into five minutes of stappage time.

89 mins - Mayembela time for dis game don end, Lepasa don enter.

Meanwhile Mayele pounce pm Xulu mistimed header, e control well but e finish narrowly miss di goal.

85 mins - Bertaud wit a good save to deny Mayembele wey almost open di scoring. Mayembele play one-two wit Mudau, di return pass see di winger free inside di area. Im take one touch before e shoot di ball straight into Bertaud.

81 mins - DRC wit a quick counterattack to catch di South Africa out by surprise. Wissa find Elia wit a pass but di winger effort to dribble im marker see am go jam im own player.

78 mins - Banza and Silas time for dis match don end. Cedric Bakambu and Fiston Mayele don enta di match.

75 mins - Chancel Mbemba wit good chance to score, di defender wey find imsef free inside di box shoot over from about four yards. Wow! Nobody wan score for dis game. If e end like dis we go enter extra-time.

72 mins - South Africa make anoda substitution. Morena wey look tired don exit di game and na Mashego take im place.

68 mins - Mayembela left foot shot dey saved by Bertaud.

67 mins - Substitution for DRC; Wissa don take di place of Diangana.

65 mins - How DRC no score for dia? Williams fail to catch one up ball, e fall for Elia wey try to cross di ball for Banza to head in but e no reach di striker instead e reach Silas wey fail to keep im shot on target.

59 mins - Substitution for South Africa: Thabang Monare and Oswin Appolis don come on, Zwane and Makgopa don go off.

Just before di substitution Elia way one better shot from a freekick straight at Williams. Di keeper first drop di shot before e later catch di ball.

54 mins - DRC dey knock on Bafana Bafana door here, dis time Silas connect well wit a cross from di left but im cutback wey look like shot end inside di arms of Williams.

52 mins - DRC come close again from Diangana. Banza knock di ball down for Diangana wey shoot am first time well ova di bar.

50 mins - Banza go close to scoring for DRC wit a volley from just inside di area. Di shot whistle past Williams left-hand post.

46 mins - Di second half don resume.

Ahead of di start of di second half, DRC make substitution. Omenuke Mfulu to take di place of Tshibola wey bin dey on yellow card.

Mama Joy

Wia dis foto come from, Getty Images

First Half

HT: South Arfrica 0-0 DR Congo

45 mins - Moutoussamy try to bend one in with im left foot from outside box, di shot rise high over di bar. We don enter into two minutes of added time.

43 mins - Mayembela produce South Africa first real chance of dis game wit a right foot curler from outside di box. Bertaud save am well.

39 mins - DRC now wit a quick break by Silas, im try to dribble im marker but Mudau stand firm to clear. Di ball fall for Diangana wey cross am into di box for Banza, di cross dey too strong e go out for goalkick.

37 mins - Moutoussamy slip den come foul Mudau. Dis na good opportunity for South Africa to threaten DRC goal. Modiba send di cross in, Batubinsika head am clear.

33 mins - Bongonda no fit kontinu, Meschack Elia don replace am.

30 mins - Theo Bongonda look like im don pick up injury. Di 28-year-old need treatment as di players don go for cooling break.

28 mins - Yellow card for Tshibola, di midfielder pull back Mudau from advancing forward.

26 mins - Simon Banza and DRC beat South Africa offside trap again wit a through ball from over di top. Di striker control well but im shot dey to weak to trouble Williams.

19 mins - Evidence Makgopa try im luck wit a volley from outside di area, im shot fly high and wide.

15 mins - No real goalmouth action so far except for some midfield challenges. Wetin dey noteworthy sha na di sound of di beating drums from supporters of DRC.

9 mins - Silas Katompa wit a good chance to open di scoring. Di forward beat Bafana Bafana offside trap and find himself wit just di keeper to beat. Silas try to dribble Williams but di goalkeeper catch di ball at im feet.

7 mins - South Africa hold dia defence line well to clear a cross from Bayeye inside di area from causing any problems.

3 mins - DRC make nine changes to dia starting lineup as coach Dessabre use dis game as opportunity to field players wey never really see game time for dis Afcon.

1 min - Dis third-place game don start and straight from kickoff DRC shoot di first shot of di game through Grady Diangana but di forward drag im shot wide.

South Africa 0-0 DR Congo

South Africa vs DR Congo lineup

South Africa XI: Williams; Mudau, Xulu, Sibisi, Modiba; Sihole, Mokena, Zwane; Mayambela, Makgopa, Morena

DR Congo XI: Yaka; Kifutu, Buduka, Tshibola, Diangana, Moutoussamy, Bongonda, Kotompa, Ditu, Mbemba, Bokote