Wetin be di impact of recognising Palestine as state - who don approve and who remain?

Foto of woman wit Palestinian flag

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Woman wit Palestinian flag for Texas

Ireland, Spain and Norway wan recognise to Palestine as a state from 28 May, as dem call for oda kontris make dem joinbodi.

Di declarations by Ireland, Spain and Norway go put pressure on oda kontries for Europe - including di UK, France and Germany - to follow dem in supporting Palestinian self-determination.

“Dis dey very significant,” one Arab diplomat tok. “E reflect European frustration with di Israeli government’ refusal to listen.

"And e put pressure on EU to follow suit.”

But Israeli ministers insist say e go encourage Hamas and reward terrorism, further reducing di chances of a negotiated settlement.

Most countries - about 139 in all - formally recognise a Palestinian state.

On May 10, 143 out of 193 members of di United Nations general assembly bin vote in favour of a Palestinian bid for full UN membership, something wey dey only open to states.

Palestine currently get a kind of observer status for UN, wey give dem a seat but not a vote for di assembly.

E dey also recognised by various international organisations including di Arab League and the Organisation of Islamic Cooperation

Some European kontries already recognise a Palestinian state. Dem be Hungary, Poland, Romania, the Czech Republic, Slovakia, and Bulgaria for 1988 and odas include Sweden, Cyprus and Malta.

But many European nations - and di United States - say dem go recognise a Palestinian state only as part of a long-term political solution to di crisis for di Middle East.

Dem dey often refer to am as di ‘two-state solution’ where both Israelis and Palestinians agree to have dia own states with dia own borders.

European kontries and US no gree over wen make dem recognise a Palestinian state.

Ireland, Spain and Norway say dem dey do am now to kick-start a political process. Dem argue say one kain sustained solution to di current crisis go dey only if both sides fit aim at some kind of political horizon.

Dis kontries dey also respond to domestic political pressures to show more support for Palestinians.

In di past, the position of many Western kontries be say Palestinian statehood suppose be a prize for a final peace agreement.

But Lord Cameron, UK Foreign Secretary, and some oda European kontries don in recent months shift dia positions, say di recognition of Palestinian statehood fit come earlier, to help drive momentum towards a political settlement.

But odas including di United States and di United Kingdom neva recognise Palestinian state.

Foto of Jonas Gahr Store for Oslo dis morning

Wia dis foto come from, BBC

Wetin we call dis foto, Jonas Gahr Store for Oslo dis morning

For February, President Macron of France say: “Di recognition of a Palestinian state no be a taboo for France.”

And earlier dis month, France support Palestinian membership of di UN for di general assembly vote.

US don privately discuss dis issue with European allies but dey more cautious and want a clearer sense of wetin di policy go mean in practice.

So di key debate behind di scenes na about wen di kontries wey never do so suppose recognise a Palestinian state: wen formal peace talks begin between Israelis and Palestinians, wen Israel and Saudi Arabia normalise diplomatic relations, wen Israel fail to undertake certain actions, or wen d Pialestinians take certain actions.

In oda words, dem want recognition of t sdiate of Palestine to be a big moment designed to achieve a diplomatic outcome.

“Na big card wey Western kontries get to play,” one Western official tok. “We no wan throway am.”

Di problem be say recognising a Palestinian state na largely a symbolic gesture if e no also address di vital questions.

Wetin di borders suppose be? Wia di capital suppose dey located? Wetin both sides suppose do first to make am happen?

Dis be difficult questions wey never dey agreed - or even answered - satisfactorily for decades.

'Di decision na in favour of peace'

On Wednesday morning, Irish PM, Simon Harris hold press conference for goment building for Dublin.

Oga Harris tok say na "important and historic day for Ireland and for Palestine".

E tok say from dia history, e know say recognition mean act of “powerful political and symbolic value,” as e dey refer to Ireland independence from Britain in di 20th Century.

E describe di Hamas attack on 7 October as "barbaric", and call "again for all hostages to be immediately returned to di arms of dia loved ones".

"But make e also dey clear, Hamas no be di Palestinian people. Today decision to recognise Palestine go help create peaceful future.

"Two-state solution na di only way out of di generational cycles of violence, retaliation and resentment...

"Just as Ireland recognition as state eventually lead to di establishment of our now peaceful republic, we believe say Palestinian statehood go contribute to peace and to reconciliation in di Middle East."

For Madrid, di Spanish Prime Minister, Pedro Sanchez tok say Israel prime minister Benjamin Netanyahu dey "still play deaf ears... e still dey bomb hospitals and schools and punishing women and children wit hunger and cold".

Spain tok say di decision "no dey against Israel" and "no be in favour of Hamas... na in favour of peace."

Di Prime Minister speech receive applause for parliament.

While addressing di parliament, e tok say Spain goment dey recognise Palestine for many reasons – “peace, justice and consistency.”

“We go make sure say di two-state solution dey respected and mutual guarantees of security must dey,” di spanish PM tok.

“E dey essential say di two sides negotiate for peace and na for dis reason we wan recognise Palestine.

"We no fit allow dis. We get obligation to act. In Palestine like in Ukraine witout double standards.

"We need to send humanitarian aid, and help to di refugees we don dey dis. But we go need do more.

“Dis recognition no dey against Israel, e no dey against di Jews.”

Norway foreign minister don post ontop X about di kontri decision to "recognise Palestine as a state".

Espen Barth Eide tok say "Two-state solution na di only viable pathway to peace for both Israel and Palestine."

“For dis critical juncture, our recognition dey come in support of di work toward comprehensive plan for regional peace."

Norway don long support two-state solution for Israel and di Palestinians and mediate di highly secretive discussion wey lead to di 1993 Oslo Accords wey result in limited self-rule by di Palestinian Authority in di West Bank and Gaza.

Israel Foreign Minister Israel Katz call di three kontris' decision "distorted step", wey show say "terrorism pay."

Simon Harris tok say  two state solution na di only path to ending "violence retribution and resentment

Wia dis foto come from, RTE

Wetin we call dis foto, Simon Harris tok say two state solution na di only path to ending "violence retribution and resentment

Hamas say today move na 'turning point'

Meanwhile, Palestinian foreign ministry react to di new development for West Bank.

"Di Ministry of Foreign Affairs and Expatriates welcome di decisions wey Spain, Norway and Ireland don take to recognise di State of Palestine," e tok.

Hamas wey take control of di Gaza Strip for 2007 don also respond.

Inside one statement to AFP, Bassem Naim, senior Hamas figure, tok say di "brave resistance" of di Palestinian people dey behind di move.

"Dis successive recognitions na di direct result of dis brave resistance and di legendary steadfastness of di Palestinian pipo," e tok.

"We believe dis go be di turning point in di international position on di Palestinian issue.

"Wit dis significant step, Spain, Norway and Ireland don once again demonstrate dia unwavering commitment to di two-state solution and to delivering di long overdue justice to di Palestinian pipo.

Di foreign minister ask oda international community to take dis decision as soon as possible.

"Further, di recognitions of Spain, Norway and Ireland, dey in line wit international law and all United Nations relevant resolutions, wey go turn to contribute positively to all international effort towards ending di Israeli Illegal occupation and achieving peace and stability in di region."