Wetin be JN.1 Covid variant wey WHO say e dey spread fast and how you fit stay safe

Covid-19

Wia dis foto come from, Getty Images

Di World Health Organization don classify one Omicron strain of coronavirus as “variant of interest” becos of di fast rate at which e take dey spread.

Dem call di sub-variant of di Omicron strain of coronavirus JN.1.

Dem don see JN.1 for many kontris around di world, wey include China, India, UK and di United States.

Dem first detect JN.1 for 12 kontris for September.

Canada, France, Singapore, Sweden, UK and US bin get di highest number of pipo wey dey suffer from di strain.

Di risk to di public currently dey low and current vaccines still fit offer protection, WHO tok.

But di health agency warn say Covid plus oda infections fit rise for di winter.

Respiratory viruses like flu, respiratory syncytial virus (RSV) and childhood pneumonia also dey on di rise for di northern hemisphere.

Di virus wey dey cause Covid dey always change and sometimes dis fit lead to new variants development.

All ova di world na Omicron be di dominant variant for some time.

Di World Health Organization (WHO) currently dey track some variants of interest wey dey linked to Omicron - including JN.1 - although none of dem dey very serious for now.

But JN.1 dey spread quickly for many parts of di world.

Currently, e be di fastest-growing variant for America.

Centres for Disease Control and Prevention tok say e account for 15-29% of infections for di kontri.

UK Health Security Agency tok say JN.1 currently make up around 7% of positive Covid tests wey dem analyse for lab. E tok say dem go continue to monitor all available data on dis plus oda variants.

Winter surge

Woman wey get Covid vaccine

Wia dis foto come from, Getty Images

JN.1 dey spread fast for all regions, probably sake of say e get additional mutation for di spike protein compared to di BA.2.86 variant wey e come from.

WHO risk assessment tok say dem dey “predict say dis variant fit give rise to Sars-Cov-2 [coronavirus] cases even as cases of oda viral and bacterial infections dey rise, especially for kontris wey de enta cold season".

Na little evidence dey to show of how capable JN.1 dey to work against di immunity wey vaccines dey offer, WHO tok.

No reports dey to show say pipo dey sick more sake of dis variant dan previous ones.

But di health body say dem gatz do more studies to work out di health impact.

To prevent infections and severe disease, WHO advise:

  • Wear mask for crowded and closed areas
  • Cover up coughs and sneezes
  • Clean your hands regularly
  • Stay up to date wit Covid and flu vaccinations, especially if vulnerablestay home if you no well
  • Get tested if you get symptoms