Court sentence Chinese man to death by hanging for killing Nigerian girlfriend

Geng Quarong and Ummulkhulsum Sani Buhari.

Kano State High Court don sentence Chinese citizen Frank Geng Quarong to death by hanging for killing im Nigerian girlfriend, Ummulkhulsum Sani Buhari.

Justice Sanusi Ado-Ma’aji for im ruling on Tuesday 26 March say dem find Quarong guilty of di crime.

Di court convict and sentence am to death by hanging till im breath im last.

Police gbab Quangrong and remand am for culpable homicide for September 2022 ova di murder of di 22-year-old for her residence for Janbulo quarters, Kumbotso LGA of Kano.

According to di prosecution, di offence go against di provision of Section 221(b) of di Penal Code Law.

Di killing of the 22-year-old university student bin shock Nigerians and pipo follow di case.

Nigeria no dey too carry out death sentences. Quarong get 90 days to appeal against di verdict.

Wen im speak on behalf of di family, di victim brother Sadiq Sani describe di sentence of death by hanging against Quarong as justice. E tok say whoever kill pesin deserve make dem kill am too.

"We tank God say e show us dis day... I pray say my sister's soul continue to rest in peace," e tell BBC.

Di victim family remember di young agriculture undergraduate as kind and jovial.

Quarong, 49, and Ms Sani bin dey for relationship since 2020 afta dem meet for one shopping mall, according to Sani.

Im bin dey work for one Nigerian textiles firm.

Nigeria currently get more dan 3,400 pipo on death row and di last execution wey dem carry out na for 2012.

Background of di case

Family and residents of Janbulo wia di late lady dey stay tell BBC Pidgin say Ummukulthum Sani and Geng bin dey date for sometime and wetin cause di problem no too dey clear at di time.

Eyewitnesses say dem slit di throat of Ummu wen dem find her.

Bappa Sani na pesin wey dey stay same street with Ummukulthum and e tok say Ummu as dem dey call her bin marry before but di marriage no last bifor she start relationship wit di Chinese national, Geng.

“We sabi her for our street wella, she bin marry before but now na divorcee she be, na afta sometime we hear say she don dey date dis Chinese man.”

“Yesterday (wen di incident happun) night, me I comot and no dey house na im pipo for my area call to tell me wetin happun say di Chinese man jump fence to gain access to her room bifor using knife to kill her.” E tok.

Ahmad Abdullahi na friend of di family and e say dem dey inside di house but step out to go chop wen di incident happun.

“Ummu house na wia I dey most of di time becos na like my family too, so me and her brother just comot to go chop around 9:35pm and by di time we come back we just see pipo full for front of di house, na dia we know wetin happun.

“Geng na her long time boyfriend - even before she marry dem dey togeda. Evribodi for di house know am, in fact sometimes na inside di house dem dey sidon gist sef.

“Wetin I know be say dem dey get issues lately and she tell am say she no do again, na wetin vex am be dat.”

E add say dem catch Geng as e bin allegedly dey try run comot di crime scene.

“Na wen e dey try escape na im some pipo catch am, in fact e first run, kon return to carry im car wey e park, na dia dem hold am.

“We rush Ummu to nearby UMC hospital but doctors tell us say she don die even bifor we reach as she lose so much blood.” E tok.