Tributes pour in for Nigerian entertainment icon Jimi Solanke

Foto of Jimi Solanke

Wia dis foto come from, Jimi Solanke/Facebook

Nigerian renowned actor, song writer, poet and play wright, Jimi Solanke die on Monday at di age of 81.

Di actor dey popular for im role in indigenous folklore as "Baba Agba" wey dey air ontop goment owned television station NTA.

Oga Solanke reportedly die on Monday for one hospital wey dey Ogun state afta im battle wit sickness.

Dapo Abiodun, govnor of Ogun state sympathise wit di family of di deceased as im break di news of di death of di actor on top im social media page X on Monday.

Di govnor tok say di actor bring richness to di tradition and culture of Yoruba race on global stage while im praise am for im commitment to di art of folklore as a true ambassador of di state.

Di govnor tok say di actor contribution to art go remain forever for history as im hail am for im artistic contribution to di global space

"Wit heavy heart, we don receive di heart breaking news of Baba Jimi Solanke passing," Dapo Abiodun tok.

"Through im powerful dramas, soulful music, captivating poetry, and oda artistic acts, im don bring di rich culture and tradition of di Yoruba race to di global stage.

"Baba Jimi Solanke contribution to di arts go forever remain dey rooted in history. im unwavering dedication, immense talent, and influence don leave everlasting impact on di global artistic landscape.

"We dey mourn di loss of dis extraordinary individual, wey all of us go miss as im don touch our lives with im extraordinary gifts."

Foto of Jimi Solanke as im dey perform ontop stage

Wia dis foto come from, Jimi Solanke/Facebook

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Nigerians dey mourn di death of di actor ontop social media as pipo dey praise am for im ogbenge role in Nigeria theatre art.

Jimi Solake hail from Ipara-Remo in Remo north local goment area Ogun State,

Di actor don contribute to global entertainment for seven decades, since 1960s and im don travel to perform for oda international festivals for Senegal and Algeria in di 1970s.

Im colleagues for di industry don use different emojis to express demselves ova im painfiul death.

Oga Solanke dey popular for im drama performance in “Death and di Kings Horseman,” “Kurunmi,” “Kongi Harvest,” “Di Divorce,” and “Ovaramwen Nogbaisi.”

Also, Oga Solanke na member of Orisun Theatre Group wey Wole Soyinka establish for 1961.