Wetin dey di 'agreement' wey Putin and Kim Jong Un sign for North Korea?

Russia President Putin and North Korea leader Kim Jobg Un

Wia dis foto come from, Reuters

Russia Vladimir Putin don leave North Korea by plane, as im don end im visit, according to Russian state-owned news agency Tass.

Kim Jong Un bin escort am all di way to di step of di plane.

Di President wey leave for midnight, go land next for Vietnam, di news agency report.

Di most significant development of di trip na di signing of one accord wia Putin and Kim agree to support each oda if either kontri dey deal with "aggression".

Wetin dey di agreement?

We dey waka jam tin for darkness wen e come to really understanding wetin President Putin and Kim Jong Un don promise one anoda.

Na so Laura Bicker, BBC China correspondent tok.

But di mutual defence pact appear to be a major reward for Kim wey also don pledge to support Putin invasion of Ukraine.

E fit get regional repercussions.

Seoul fit change dia mind about supplying weapons to Ukraine. E fit also draw South Korea and Japan closer. Di two historical rivals don already set aside some of dia differences in di last two years to sign one trilateral agreement with US in di hope of facing North Korea and di growing influence of China.

E dey unlikely say Beijing go show any disapproval for public, but China fit wan distance imself from dis agreement. Dis supposed to be a year of friendship between Pyongyang and China as dem celebrate 75 years of ties.

Kim suppose, in theory, meet President Xi at some point dis year.

US go likely voice out more and view dis as a rising threat. But di two candidates wey dey go for president get very different views on Putin and Kim.

Russia and North Korea fit wan wait to see if na Joe Biden, wey don strengthen US alliances for Asia, or Donald Trump wey dey more unpredictable, wey claim say e still dey in touch with Kim afta dia three meetings.

Chad O’Carroll, one North Korean specialist from NK News, tok for X, formerly Twitter, say di clause fit open di door to conflict-related co-operation, including di possibility of North Korean soldiers assisting Russia for Ukraine.

Victor Cha, di Korea Chair for di Centre for Strategic and International Studies, say di pact represent a “renewal of Cold War-era security guarantees”.

Some news headlines dey describe di visit as a genuine global threat. However, Aidan Foster-Carter from Leeds University, wey don follow North Korea for more dan 50 years, write for X say, “calm down”.

Foster-Carter say e no dey in Putin interest to do adventure for Korea. Moscow remember 1950-1953.

Putin thank North Korea for hosting orphans of Russian soldiers

Russia President also thank di leader of North Korea for hosting di children of Russia soldiers wey die for Ukraine.

Putin reveal dis one during im friendly state visit to North Korea Kim Jong Un, say di orphans of di dead soldiers bin dey Songdowon summer camp for di kontri Pacific coast.

"We highly value dis genuine act of care and friendship," Putin say.

E also praise di continuous development of tourism ties between di two kontris, come add say Russia groups dey organise summer tours to Korea seaside resorts.

Russia tourists don dey visit North Korea for some few months now.

For early February, around 100 Russians travel go North Korea for one ski trip – dem be di first tourists wey dem don allow to enta di kontri since di coronavirus pandemic.

'Friendly official visit'

Putin friendly official visit come with plenty, plenty colourful and ogbonge celebration for Pyongyang to welcome am.

Kim Jong Un welcome di president wit ogbonge formal ceremony wia children sing, military waka and do parade.

Di two sides exchange gift, and tori be say Oga Kim receive anoda luxury car, admiral dagger plus tea set.

Di two speak togeda for two hours, come sign one deal to help each oda if any kontri atack dem.

Vladimir Putin land Pyongyang for midnight on Tuesday, to officially begin im first visit to di kontri inside 24 years.

Among di officials wey follow Putin go dis friendly visit na, Defence Minister Andrei Belousov, Foreign Minister Sergei Lavrov and di heads of Russian space agency.

At least one fighter jet escort Putin plane as im fly over Russia to eastern Siberia city of Yakutsk on Tuesday.

Dis na di first time tori dey enta news say military aircraft escort am inside di kontri, according to one investigation outlet Agentstvo.

Before, Putin planes bin dey only receive armed escort during foreign visits.

Russia pipo bin post videos on social media of at least one Sukhoi Su-30 jet wey bin dey escort Putin plane before e land for Yakutsk, Agentsvo report.

Dis picture from Getty show one of several billboards for Pyongyang to welcome Vladimir Putin

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis picture from Getty show one of several billboards for Pyongyang to welcome Vladimir Putin

Purpose of visit

E get plenty speculation about wetin exactly be di purpose of dis visit. And e be like security of supplies na di koko.

Russia fit dey find ammunition, construction workers, and even volunteers wey go gree go to di front line for Ukraine, political scientist and Putin supporter, Sergei Markov tok.

In return, Pyongyang fit get Russian produce, and technological help for military goals, including im long-range missile programme wey go ultimately fit dey within striking distance of United States, Markov add.

Russia wey dey share land border with North Korea, get history of long time relationship, since Soviet Union bin help establish di small kontri afta Korea War for di 1950s.

And since di fall of di USSR, Russia still be one of di few kontris wey bin still get working relationship wit Pyongyang.

Although di level of relationship no reach as e bin be during di Soviet Union, e don graduate now from mutual pleasantries to mutual benefits.

Dis na di second time wey Putin dey visit North Korea since im enta power.

Im first visit na 24 years ago, just afta im become president, to meet Kim Jong Un papa, Kim Jong Il.

As par dis visit, Kremlin say dem get opportunity for "very deep relations" between Russia and North Korea, come add say dis no suppose concern anyone.

Why dis visit dey worry di west?

Dis relationship wey dey grow between Moscow and Pyongyang dey worry US and Western kontris.

By visiting North Korea, Putin fit dey show im enemies say im fit - and im go - do wetin im want like:

Find way to dodge di sanctions wey di West sama im kontri.

Convince odas to break di sanctions and sell Russia weapons

Get new relationship wit kontris around di world, even as im dey do im “special military operation” for Ukraine.

Moscow say afta im visit to North Korea, Putin go from dia travel go Vietnam.