Top richest pipo and families for UK - who dem be and how dem get dia wealth

Top richest pipo and families for UK

Wia dis foto come from, The Sunday Times 2024

Wetin we call dis foto, Top richest pipo and families for UK

One new report don show di pipo and families wey be di richest for di United Kigndom.

Di new list show wia His Royal Majesty di King and di Prime Minister Rishi Sunak dey in terms of dia worth.

According to di Sunday Times Rich List, di personal wealth of Sunak and im wife Akshata Murty rise by £122m last year- but dem even dey di top 100.

Di couple bin get fortune wey di worth dey estimated at £651m for di latest list afta e go up from £529m for 2023.

E mean di Sunak family dey richer dan di King, according to di annual list of di UK most wealthy pipo.

King Charles III bin dey ranked high pass di Sunak family last year, but im personal fortune grow more ova di past year.

For 2022, di Sunak family dey ranked higher dan di late Queen- as Elizabeth II personal fortune dat year dey evaluated at £370m.

Meanwhile, to dey estimate di personal fortunes of monarchs dey tricky. But di wider wealth of di monarchy - wey include various estates and palaces dey estimated at dozens of billions of pounds.

Sunak bin move high di list sake of im wife Ms Murty wey get shares for Infosys, di Indian IT giant wey her father bin co-found.

PM Sunak dey become di first front-line politician to feature on di Sunday Times annual wealth list since dia 35-year history.

For dat point, Sunak family wealth dey estimated at £730m.

His Royal Majesty di King rise to £610m.

Wia dis foto come from, BBC/EPA

Who make di top 10?

According to di Sunday Times, di 10 richest families and individuals for di UK and di primary source of dia wealth na:

  • Gopi Hinduja and family - £37.2bn (industry and finance)
  • Sir Leonard Blavatnik - £29.25bn (investment, music and media)
  • David and Simon Reuben and family - £24.98bn (property and internet)
  • Sir Jim Ratcliffe - £23.52bn (chemicals)
  • Sir James Dyson and family - £20.8bn (household goods and technology)
  • Barnaby and Merlin Swire and family - £17.2bn (transport)
  • Idan Ofer - £14.96bn (shipping)
  • Lakshmi Mittal and family - £14.92bn (steel)
  • Guy, George, Alannah and Galen Weston and family - £14.49bn (retail and real estate interests, including Primark)
  • John Fredriksen and family- £12.87bn (shipping and oil services)

Odas include Sunak and Murty wey dey number 245 wit £651m worth and dia source na Technology and hedge fund: Infosys; di King dey number 258 wit £610m worth.

One African billionaire wit British history Sir Mo Ibrahim dey di list for number 160 wit £1.031bn worth and im source na Mobile phones: Celtel.