'We finally lose am' - AGN president confam actor Junior Pope death

Junior Pope

Wia dis foto come from, JUNIOR POPE/INSTAGRAM

President of di Actors Guild of Nigeria (AGN) Emeka Rollas Ejezie don confam di death of ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope.

Oga Rollas confam dis for post e do on im Facebook account on Wednesday, 11 April.

Dis dey come afta im previous confirmation wey im say di actor bin dey alive afta tori of im death bin go viral.

“Wetin God no fit do no exist. Junior Pope dey alive. E dey take treatment for hospital," Emeka bin tok for im previous confirmation.

But for im latest post, Emeka tok say im make di previous post out of excitement wen dem notice say Junior Pope tinglin fingers.

"E dey so so sad say our joy dey shortlived.

"My first post na out of excitement wen we notice im tinglin fingers. Two notable hospitals bin try dia best to revive am but to no avail. God know di best.

"We finally lose am.

"Mr Friday corpse don dey identified but three other corpses neva dey found," Emeka write for im Facebook account.

Junior Pope is dead

Wia dis foto come from, BBC News

Wetin we call dis foto, Screenshot from Emeka Rollas Facebook post

Earlier, report bin spread say Junior Pope bin drown afta boat wey im and some movie crew members dey inside bin capsize for River Niger.

Afta di viral tori, anoda tori begin spread say wen dem take Junior Pope to mortuary, di mortuary attendant tok say di actor neva die.

But wit di latest confirmation from di AGN president, fans don enta social media again just like di first time di news of im death break to begin mourn di ogbonge actor.

Apart from Junior Pope, four oda crew members also lose dia lives sake of di accident, according to AGN, and dem don identify di deadi bodi of one Mr Friday.

AGN take action

AGN don suspend till further notice all movies wey involve riverine areas and boat riding sake of di accident wey claim lives of dia colleagues.

Dem also tok say no shoot on all locations nationwide on Thursday 11 April 2024.

AGN also suspend di movie titled Another Side of Life till further notice. Dis na di movie Junior Pope and odas wey lose dia lives bin go shoot for Delta State.

"No actor dey allowed to work wit Adamma Luke as producer till further notice. While we keep searching for di bodis of di remaining pesins, may dia soul rest in peace," AGN tok for dia statement wey Emeka sign.

Di day of di boat accident, di last post Junior Pope make on im Instagram account na about how actors risk dia lives to entertain dia fans.

Junior say im bin dey cross River Niger on Tuesday 9 April wit no life jacket and add say im get three pikin dem and na im go raise dem.

"Na only dem born oh, na only me dem born, I get three children na me go raise dem, I get three children na me go raise dem oh, bros abeg, oh Jesus wetin be dis, bros abeg na abeg...

"Abeg take am small small... See di risk we take, pipo, to entertain you, live and direct on River Niger," Junior Pope tok.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post

Who be Junior Pope

Junior Pope come from Ukehe, Enugu State, and im be di sixth among eight pikin wey im parent born and dem born am for Bamenda, Cameroon.

Im papa be trader and im mama comot for Nigeria go Cameroon during di civil war.

Junior Pope attend primary and secondary school education for Cameroon, e later come back to Nigeria for university education for University of Nigeria Nsukka.

Di Nollywood actor graduate wit degree in Accounting but start to dey act feem Nollywood movies for 2006.

For 2007, e become famous afta im role for “Secret Adventures” wey Tchidi Chikere be di feem director.

E don act for ova 100 Nollywood feems such as: “Secret Adventures”, “Vengeance of Bullet”, “Di Cat”, “Mad sex”, “Bitter Generation”, “Di Generals”, “Wrong Initiation” among odas.

For 2010, im win im first award as di Most Promising Nollywood Actor from Entertainment Factory Awards.

E sabi act role wey pipo dey see am as antagonist such as criminal, villain, armed robber, militant and hitman. And e don act wit oda actors like Emma Ehumadu, Sylvester Madu, Zubby Michael, Jim Iyke, Alaso Wariboko, Gentle Jack, Hanks Anuku and Jerry Amilo.

Junior Pope marry im long-time girlfriend for 2014, Jennifer Awele, wey im meet for Facebook and she be di mama of im three boys.

For 2021, Junior Pope tank God say im and im family no die inside one fire incident wey happun for dia house for midnight.

‘‘Join Me In Tankin God Ooooooooo. My house almost catch fire while my family dey sleep. But God interven. My hands dey clean Oooooooooooo, (Akam di Ocha). God na di Greatest. My family and me dey safe,” e tok.