Nigeria receive 10,000 doses of Mpox vaccines

Nigeria goment recieve Mpox vaccines

Di first delivery of 10,000 Mpox vaccines don arrive for Nigeria - a donation by di United States Agency for International Development (USAID).

Di Ministry of Health take delivery of di vaccines for Abuja on Monday afternoon, and dem bin don announce say administration of di vaccine go start wit healthcare workers.

Di vaccines na to combat 'Clade II', wey be di less dangerous strain of di Mpox virus wey don dey spread for di kontri since 2017.

So far, 18 kontris across di world, including Nigeria, don record cases of Mpox as di World Health Organisation (WHO) tok say a new strain of di virus dey spread across Africa now and e fit dey deadlier dan di former strain.

Di kontris wia di virus don spread include: Burundi, Cameroon, Central African Republic, Pakistan, Democratic Republic of the Congo, Ghana, Uganda, Ivory Coast, Kenya, Liberia, Mozambique, Nigeria, South Africa, the Philippines, Republic of Congo, Rwanda, Sweden and Thailand.

Earlier in August, di WHO declare Mpox a public health emergency of international concern, but di Director General, Tedros Ghebreyesus add say di virus "no be di new Covid".

Na only two companies for di world dey manufacture di Mpox vaccine: Bavarian Nordic for Denmark and KM Biologics for Japan.

Di Bavarian Nordic vaccine - wey be di type di US dash Nigeria - dey cost $100 for one dose, but di price of di KM Biologics vaccine no dey known.

Data from di National Centre for Disease Control (NCDC) show say Nigeria don get 802 suspected cases of Mpox, 40 confirmed cases and no deaths.

Thirty Local Government Areas for 19 out of di 36 States of di Federation and di Federal Capital Territory don get confirmed cases of di virus.

"To prevent Mpox, we dey advise members of di public to always dey practise infection prevention and control measures wey dey proven to limit di spread of infection," NCDC tok for dia X handle.

Some of di measures include:

  • Avoid touching, sharing, or handling clothes of pesin wey dey infected
  • Avoid close or skin to skin contact wit pesin wey dey show signs of Mpox infection
  • Dey wash your hands frequently wit soap and running water, cook all meat well well bifor you eat am
  • Wear glove of clothe wey fit protect you wen you dey handle sick animal or pipo
  • Visit di nearest healthcare centre immediately you see any symptoms of mpox

According to WHO, na just about 10 percent of di pipo wey get Mpox dey die sake of di infection, dis mean to say di death rate not too dey high.

"E dey important to note say death rates fit dey different sake of several factors, like access to healthcare and underlying condition of di patient," di UN agency tok.

In most cases, di Mpox dey go away by imsef afta few weeks of supportive care, but for some pipo di sickness fit dey severe or lead to complications and eventual death.

Newborn babies, children, women wey get bele and pipo wey get underlying immune deficiencies - like advanced HIV - fit dey at higher risk of more serious Mpox disease and death.

As e be now, di outbreak of Mpox dey more severe for Democratic Republic of Congo. Di kontri get 27,000 suspected cases, about 3000 confirmed cases and 1,100 deaths, according to goment figures.

Di death toll na majorly among children.