Nigeria Immigration tok why dem ask Ayra Starr to comot eyelashes before passport capturing

Ayra Starr

Wia dis foto come from, Getty Images

Nigeria immigration service (NIS) don explain why e dey compulsory for pipo with eyelashes to remove am wen dem wan do capturing for international passport.

Dis dey come afta Nigerian singer Ayra Starr complain bitterly for twitter about how dem force her to remove her eyelashes.

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Twitter post

Nigeria Immigration explain say di removing of eyelashes na global rules wey everbody must follow no mata dia class.

"As e be ground rule globally, wen individuals, regardless of societal class, come for data capturing for any of our passport offices, we dey usually always advise, inform and beg dem to present demsef as naturally as dem fit possibly do."

"Di actual capturing dey take less than 10mins; dis no be so much time wey pesin no fit sacrifice ito get di accurate biometrics of di individual."

Dem add say rules na rules, and so e dey binding on everyone and apologize give Ayra star for any discomfort wey dis cost her.

Dress code and standard for passport capturing

Based on eyelash removal and oda issues wey pipo don bin complain about if dem go passport office for capturing, BBC pidgin ask NIS wetin pipo need to know.

Tony Akuneme wey be tok-tok pesin for Nigeria Immigration Service tell us say:

"E get International civil Aviation Standard wey dey regulate travel documents. Dis passport na global means of Identity wey carry a lot of intergrity and no be something wey di goment go wan play with.

Oga Tony go furher to explain some of di things wey no dey allowed for capturing.

Nose Ring

"Any mark wey no be part of your permanent features no dey allowed for international or global standard for identification. We no need any artificial tin"

"For instance if na tribal mark, e always dey your face but if na nose ring, e no dey allowed as e dey confusing becos you fit take am off at anytime."

E add say na di same standard di whole world dey follow na im Nigeria dey use.

"Anybody fit go di International Civil Aviation Organization (ICAO )website to check di global standard."

Guys wey braide hair

Concerning guys wey dey braide dia hair, oga Tony say dis no dey acceptable for capturing.

"Make guys wey dey braide dia hair no come and expect us to accept am, e no dey acceptable."

Dreadlocks

Then for those with dreadlocks, oga say if e dey natural dem go accept but if no be natural dreadlock, e no dey acceptable.

"If di no be natural dreadlocks, e no dey accptable."

Color of dress

According to Oga Akuneme, pipo need to avoid wearing white cloths instead make dem wear dark color wey go contrast with di white internationally accepted background.

"Di international standard na white background, so anything wey no contrast di white background no give di best production in terms of appearance of di photograph."

"So if we dey look at a foto wey get white background, dat means you gatz wear dark colors wey go be opposite of di background."

Nigeria Immigration

Wia dis foto come from, TWITTER/NIGERIA IMMIGRATION SERVICE

Di immigration tok-tok pesin add say aside from di guidelines, pipo need to know some oda impotant tins about di passport.

"Pipo need to start early for di application of dia passport. Once pesin passport don dey less than six months to expire, e dey free to re-aply. Dis dey very important."

"Some pipo go just show up say dem wan bin travel but no know say dia passport don expire and dem go begin make trouble say dem want am right now but e no dey possible."

Tony Akuneme say dem also want pipo to know say no be only passport dem fit use as means of identification.

Dis na becos a lot of pipo dey come get passport becos dem want get money from western union or clear dia motor from wharf but dem fit use oda means for identification and no be only passport.

E say anoda mistake wey pipo dey do wen dem come to apply for passport, dem no dey use dia correct conctacts or emails as some of dem dey use third party or agents.

And so dia passport go dey ready but NIS no fit reach di owners and dis don lead to plenti uncollected passports.

Right now, oga Tony say dem get 140,000 uncollected passport across di kontri.

"We get ova 140,000 issued passport wey we no fit reach di appllicant becos dem no use dia accurate contact details or emails."