Why di death of Navalny na big deal for Russia

Pesin dey hold Navalny picture afta tori of im death burst

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pesin dey hold Navalny picture afta tori of im death burst

Time bin dey wen tori pipo bin dey ask Alexei Navalny why e still dey free. Di second most asked question na weda e fear for im life.

Wen Navalny bin dey poisoned wit novichok nerve agent for August 2020, dem stop to dey ask.

Now di Russian prison service don announce say Vladimir Putin most dangerous political opponent don die.

For long, di Kremlin bin dey do like pesin wey get odeshi. E get supporters all ova di kontri and di kain political network wey no oda rival of Vladimir Putin don get.

Im feems wia e dey expose high-level corruption bin dey go viral as pipo dey watch and share am and often, e carry supporters enta street for mass protest.

Di Kremlin no like am, even Putin no gree call Navalny name.

But dem bin reason say to arrest am fit lead to serious gbege wey go affect Putin hold on power.

Navalny still spend small time for prison, e get criminal charges but no prison sentence.

Den for August 2020, di Russian opposition activist collapse from flight wey bin comot from Siberia, if no be say di pilot quick land, Navalny for die.

Tests for Germany confam say dem bin try kill am wit military grade nerve agent wey dem bin create during Soviet times.

Dis attack bin happun around di same time wey protest bin burst for neighbouring Belarus against di authoritarian rule of Alexander Lukashenko, wey be Putin ogbonge ally. Dis na time wey Kremlin bin dey feel heat.

Wen Navalny recover finish, e quick graim say e no ever safe for Russia.

Di state prison service bin warn am say e go go prison, if e come back, but Navalny no gree run.

Pipo dey protest

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Navalny bin get di ginger to make pipo comot for street to protest

For Moscow, BBC tori pesin, Sarah Rainsford report on di many Navalny protest, im court palaca and as im dey try run for political office.

No be everybody bin like am, opposition ranks for Russia no dey like each oda like dat.

But im na ogbonge speaker, e sabi use social media and much more.

So e no be shock wen e go back Moscow for January 2021 even wit everytin and Navalny no shock wen dem arrest am as e come.

But e kontinu to dey tok weda na for court or and afta for prison.

E go appear for video for im hearings for di multiple criminal cases wey dem bring on top am and dem kontinu to grow.

Yet even though e slim, dem shave im head, Nalvany go still dey tok wit ginger even from prison.

Oneo f di last videos wey dem bin see Navalny alive

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One of di last videos wey dem bin see Navalny alive

For im last appearance, di day before dem say im die, e still dey joke.

Nalvany still hold on to di belief wey im team call "di beautiful Russia of di future" wey be wen Putin long rule go finish and say political change go fit happun for di kontri.

But afta dem arrest am na wen Putin start im war on Ukraine, dem ban Navalny political organisation as "extremist" and arrest im members.

Oda popular critics of Putin don dey prison or don run comot di kontri.

For dem, and all di pipo wey bin imagine different Russia, di news of Navalny death mean say dis dream fit long.

Wetin pipo dey tok on top di tori of Navalny death

Protesters with im pictures

Wia dis foto come from, Reuters

Many pipo, including world leaders don comot to slam Putin afta di announcement of Navalny death by di Russia prison service.

Navalny wife, Yulia Navalnaya tok say she neva know if di tori na true and say if na true Vladimir Putin go hear am.

Pipo for across di world don comot to protest di death of di activists sotay for Russia, police don arrest pass 100 pipo wey do dia own protest in di kontri.

Tori be say Russian officials dey run kiti-kata to quickly comot any flowers wey pipo drop to honour di 47 year old opposition leader.

Nalvany protest for France

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For Paros, pme Navalny supporter dey put candle for vigil in im memory
Protest for London

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, For London, plenti pipo tanda outside di Russian embassy ofr di city
Switzerland protest

Wia dis foto come from, Shutterstock

Wetin we call dis foto, Pipo drop flowers and candles for di Russian embassy for Switzerland
Protests for Moscow

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo drop plenti flowers for Moscow but Russian officials just tanda near am and tori be say dem comot am

Ukrainian President Volodymyr Zelensky don call Russian President Vladimir Putin as "agbero" for Munich Security Conference.

E tok say di activist death na scope by Putin to send di world "Clear message".

Meanwhile UK foreign secretary say di UK go take action on di death of di activist.

Lord Cameron say e go get meeting wit oda foreign ministers from di group of G7 nations and go try convince dem to take action too.