How pesin die, odas injure inside flight wey enta turbulence and suddenly drop for air

Di Singapore-bound Boeing 777-300ER bin divert go Bangkok

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Na 229 pipo dey inside di flight wen e suddenly drop for air

One pesin don die and more dan 30 more pipo bin injure inside di Singapore Airlines flight wey comot London.

Di Singapore-bound Boeing 777-300ER bin divert go Bangkok and make an emergency landing at 15:45 local time (08:00 GMT).

One British man wey be 73-years-old bin die for di flight.

Wetin cause di wahala be say di flight dey hit by serious turbulence (movement wey dey make di flight dey unstable on-air).

Di flight bin dey carry a total of 211 passengers and 18 crew (making 229 onboard).

Di Singapore Airlines flight bin take off from Heathrow Airport at 22:30 GMT on Monday night.

Di plane na one 16-year-old Boeing 777.

According to di airline, dem get serious - severe turbulence en-route, and di aircraft divert to Bangkok, arriving roughly 11 and a half hours afta dia departure.

According to passengers wey dey inside di flight, di aircraft bin suddenly drop wey make objects wey dey inside dey fall from di cabin.

Singapore Airlines "offer dia deepest condolences to di family of di deceased," for one statement wey dem release.

Di airline add say dem dey work wit Thai authorities to provide medical assistance to passengers, and dem don send team to Bangkok to provide any additional assistance wey dem go need.

Singapore Airlines

Wia dis foto come from, Getty Images

Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Thai authorities don send ambulances and emergency teams to di Suvarnabhumi Airport.

Singapore Transport Minister Chee Hong Tat say di goment go provide assistance to di passengers and dia families.

"I dey deeply saddened to learn about di incident onboard Singapore Airlines flight SQ321 from London Heathrow to Singapore," e tok for one statement on Facebook.

E still dey unclear on wetin happun on board di flight.

Turbulence fit dey serious sake of say sometimes e fit dey predicted - and pilots dey radio each oda to give advance warnings.

But sadly, turbulence fit also come out of nowhere. Even though na weather phenomenon, turbulence fit happun anywia and in any condition.

Bottles, jugs, fruits and oda tins wey fall during di turbulence

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Photo show inside di plane afta di turbulence. Objects bin fall to di ground as di flight drop.

How e happun

One passenger tell Reuters news agency say di aircraft bin suddenly start "dey go up and begin to shake".

Im add say di flight just drop from di air and pipo wey no wear dia seatbelt dey affected as dem begin fall and dem dey thrown into di air.

"So I begin dey ready for wetin dey happun, and very suddenly, a very dramatic drop happun so everyone wey dey dia seat but no wear seatbelt dey thrown immediately into di ceiling," 28-year-old student Dzafran Azmir tok.

"Some pipo hit dia heads for di baggage cabin overhead, dem hit di places wia lights and masks dey."

Photo show inside di plane afta di turbulence, oxygen masks bin come out

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Photo show inside di plane afta di turbulence.

'31 pipo dey hospital'

Di airline say 31 pipo wey also dey inside di flight don already dey hospital sake of di effect of di turbulence.

"Di remaining passengers and crew dey under examination and go also receive treatment wia necessary for Suvarnabhumi International Airport inside Bangkok."

Di authority say one 73-year-old British national wey die inside di aircraft fit be sake of heart attack.

Seven pipo currently dey for critical condition sake of di severe turbulence.

Tori be say about 53 passengers currently dey hurt as more operations still dey go on to check on di remaining pipo.

Inside di plane afta di turbulence

Wia dis foto come from, Reuters

'Di plane drop and pipo begin dey scream', passenger tell BBC

One passenger wey dey inside di Singapore Airlines flight tell BBC say di aircraft bin “suddenly drop” as objects dey fly around di cabin sake of di turbulence.

“I dey covered in coffee,” Andrew Davies from London tell BBC.

“During di few seconds wey di plane dey drop, plenty pipo scream well-well and objects dey fall for ground."

As di aircraft bin settle small, Andrew say im dey able to help one lady wey dey "scream in agony" and she get "cut ontop her head".

"One of di Singapore Airlines crew say na by far di worst in her 30 years of flying," Andrew tok.

E describe as e see some passengers dey give first aid and also dey shout for defibrillator.

"So many injured pipo - head lacerations, bleeding ears," Andrew tok. "One lady bin dey scream in pain with a bad back. I no fit help her - I just give her water.

"Plenty pipo injure - including di air stewards wey bin remain calm and do everything dem fit.

"I wish I for fit help more."

Na total of 211 passengers and 18 crew members bin dey onboard.

Di nationalities of di passengers na:

56 from Australia, 47 from the United Kingdom, 41 from Singapore, 23 from New Zealand, 16 from Malaysia, Five from the Philippines, Four from Ireland, Four from the US, Three from India, Two from Indonesia, Two from Myanmar.

Two from Spain, Two from Canada, One from Germany, One from Israel, One from Iceland, One from South Korea.

Wetin be turbulence?

Turbulence na irregular motion for di air wey fit result in different conditions.

Di conditions fit be atmosphere pressure, weather conditions or thunderstorms- and di smooth air and flow of high-altitude winds go affect di aircraft.

Research say di condition fit happun unexpectedly even wen di sky dey clear.

Turbulence fit cause sudden jump wey fit affect flight for air and passengers fit injure if dem no use dia seatbelt.

Turbulence dey most commonly caused by aircraft flying through cloud but e also dey possible make di air clear and e go still happun.

“Injuries from severe turbulence dey relatively rare. However, severe turbulence fit dey dramatic and lead to severe injuries or sadly a fatality for dis case," aviation expert John Strickland tok.

Ogbonge sabi pesin Strickland say flight crews also dey trained on how to respond to turbulence for air.

"No be for notin say airlines dey recommend say make passengers dey keep dia seat belts loosely fastened throughout a flight if e dey long or short".

How dangerous turbulence be?

Aircraft dey designed to take di worst wey turbulence fit throw dia way, na so Oga Gratton, wey be associate professor of aviation and di environment for Cranfield University tok.

E dey "unlikely" say turbulence go eva destroy aircraft, e add.

Make we tok, e no do aircraft any good, dat na why pilots try to avoid am or slow down - and turn di seatbelt sign on.

Sabi pipo say for extreme scenarios, turbulence fit cause structural damage to plane sake of how strong di winds fit be.

Serious turbulence fit dey dangerous to air passengers sake of di violent motion wey e fit cause, wey fit throw anyone wey no wear seatbelt across di cabin.

But aviation safety sabi pipo tok say deaths and injuries wey turbulence cause no common.

John Strickland, one aviation sabi pesin. tok say injuries from veri bad turbulence no common for context of millions of flights wey dey operation.

Di US National Transportation Safety Board tok say e get 163 "serious turbulence injuries" on US-based airlines between 2009 and 2022 - e be average of about 12 per year.

How pilots dey handle turbulence?

Pilots go get particular aviation forecasts bifor dem fly, wey go include meteorological data.

Dey go dey be able to study dis informate wen dem dey plan dia routes.

Dis mean say dem suppose dey able to avoid separate thunderstorms, for example. But "clear air" turbulence dey little more tricky to avoid.

Oda aircraft ahead of dem on di same routes go also report any turbulence, Oga Gratton tok.

Pilots go try avoid dis areas, or slow di plane down to reduce di impact.

Crews also get training on how to respond to turbulence.

Wetin passengers fit do to stay safe?

For passengers, di advice na to stay strapped in and no get any heavy objects out.

Pilots dey advise passengers say make dem dey strapped in all di time, exactly sake of say turbulence fit dey unpredictable.

Turbulence dey become more frequent?

Some researchers tink say climate change don make turbulence more likely.

Last year, scientists for Reading University for di UK find say severe turbulence don increase by 55% between 1979 and 2020 for busy North Atlantic route.

Dem bin put di increase down to changes for wind speed for high altitudes due to warmer air from carbon emissions.

Guy Gratton suggest say we dey encounter turbulence more, and add say anoda reason for dis fit be di fact say we dey fly more.

Dis mean say di skies dey busier, and e dey make pilot decision to avoid turbulence trickier as dem gatz maintain a safe minimum distance from oda aircraft for di area.