Idris Elba blast those wey say black pipo no fit get coronavirus, tok about Sabrina

Idris Elba and im wife Sabrina

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Popular British actor Idris Elba don rubbish all di tok say black pipo no fit catch Covid-19

Popular British actor Idris Elba don rubbish all di tok say black pipo no fit catch Covid-19, inside im first online appearance since im announce say di virus dey im body.

"E no correct, e no make sense, e dey dangerous," oga Elba hala for di beginning of im Twitter live video wey e do from house on Tuesday night, as im dey self-isolate.

Some pipo for recent weeks begin spread unverified tok-tok say 'Covid-19 no fit survive for black pesin body', maybe because dem reason am say di number of cases for Africa dey low.

"Abeg no dey send all di conspiracy theory about coronavirus, abeg guys, dis no be di time for am. If you dey do am abeg stop!"

"Pipo need to know di facts, pipo need to know di truth, so dat dem go fit protect demsef," di Hollywood megastar add.

During di live video, oga Elba take kweshion from im fans ontop mata like why im wife Sabrina no isolate herself afta test comot say im dey positive.

Skip Twitter post
Allow Twitter content?

Dis article contain content wey Twitter provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Twitter cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Twitter post

E say im wife no dey country when im enter go do di test but wen she hear she gatz come back to support am, and na decision wey di two of dem decide to take. As na just di two of dem dey live togeda.

Idris based on di touch-touch im do with anoda star (wey later test positive) im fit don get di virus for body since 4 March.

Wetin we call dis Video, Coronavirus tips: How to self-isolate to prevent di spread of Covid-19

On 16 March, fans all across di world begin send dia "sorry" message to di Hollywood star and im wife Sabrina afta e confam say e test positive.

When one fan ask am how im dey feel, Idris say im dey fine, say im body no hot, but say because of asthma im don get since birth, im na high risk case.