Players affected by coronavirus: See football games, celeb shows, oda big gigs wey Covid-19 disease don affect

Pesin wey cover nose

Wia dis foto come from, Getty Images

Di outbreak of coronavirus don cause make dem cancel plenty events, from football matches wey dem don postpone to music concerts.

European Champions League, La Liga, Premier League and many concerts including Coachella music festival dey among some of di events wey organisers don postpone sake of coronavirus.

World Health Organization don declare say coronavirus na pandemic, dis one mean say, e don dey for evri part of di world.

BBC Pidgin don compile some of di events wey di Covid-19 pandemic don affect.

More than 125,000 pipo na im don get di Covid-19 disease inside 118 kontris around di world, according to di World Health Organization. Di total number of deaths now na more than 4,600.

We go dey add to di list as more tori dey commot.